CORRECT LYRICS

Lyrics : Why

It's Victor AD na na na

Bros E for better if them slap me
Say e for better make dem throw me punch
I just got back from London
Aih! my people still dey sell their vote
For bag of rice wey no carry beans
The food no go complete if e no carry

Aih
Before I see welcome to Nigeria
Na blackout I take know say I dey Nigeria
It’s so painful
Say the story no change at all
And it's so painful
Say the leaders no change at all

I believe say you get the voltage and power to rise when I fall
Na the reason why I put you there
I believe say you get everything to make this people tall
Na the reason why I put you there

And now you don dey break my heart
Say, make the people cry
No be the reason why I put you there
And if I get the power to change it, I go bring you down
But who next I go put for there?
And I say
Oh why? oh why? oh
Oh why? oh why? oh
Eheh
Oh why? oh why? oh
Oh why? oh why? oh

What if I tell you 'I was right’
And I tell you 'you were wrong?'
That everything will be alright
But only inside my song
You will find peace of mind
Because in a crazy world
Who everybody dey call craze, na em normal
Check Instablog

Which country for this world dey use 50 years do light
I dey London dey drive, I no even use full light
Cause everywhere bright
Even bright pa** we leaders
For their mind, we be smallie with primary three reader

Tobore say he dey go stadium
Na big kolo
As we dey see am so, e wear reach for party polo
So when you feel say you dey fool us with yeye promise
We dey fool you too
Your lies dey make us wan vomit
I believe say you get the voltage and power to rise when I fall
Na the reason why I put you there
I believe say you get everything to make this people tall
Na the reason why I put you there

And now you don dey break my heart
Say, make the people cry
No be the reason why I put you there
And if I get the power to change it, I go bring you down
But who next I go put for there?

And I say
Oh why? oh why? oh
Oh why? oh why? oh
Eheh
Oh why? oh why? oh
Oh why? oh why? oh
As e dey pain me eh