AJOUTER PAROLES
Top 100
Sorties d'albums
artistes
Communauté
Espagnol
Portuguais
Anglais
Correction Paroles
Kettle (Story Of Okiemute)
par
ERIGGA PAPER BOI
Retour
Paroles
Oh na na na na, omo, its Paper boi, you know the voltage nah It’s your boi Erigga Paper boi & Graham D baba Omo E get wetin play when ah go Accra recently mehn! Ah nor fit yarn am, so ah gats put, ah gats express am through music you understand About my guy Okiemute Okiemute say like this he wan go join HK For Accra nothing dey him hand only 10k Eribaba believe me ah nor be JK Before ah waka we fit gather smoke your SK As we dey smoke ah tell am say na Akanuche E work for me nor mean say e go work for Uche He say Erigga lock up, who I wan follow pench Na my real guy beside, ah dey expect one cash On he way to Lagos he receive alert Family land na he sell the boi too get heart Enter Accra, he guys dey hail am Bossu He nor dey hustle every night steady bottle If dem wan cook for house nai him dey go withdraw Small small big Man for Accra don poor Nobody tell am around 10 o’clock for night Dem send am message lock gate, fling him things outside (GRAHAM D) Because E work for Mr A like that No mean say E go work ki for Mr B like that Because your friend travel go Ghana en make him money You think say if you travel you go make am too Use your sense waka no be leg The hustle wey we dey so na God abeg If not for the Streets, boiz for dey beg Na only God fit to change leggedis to Benz Akaraka di iche Akaraka di iche Weluche gi ga ije oooh no Every mallam with him kettle And every body with him grace (X2) Habeg!!! According to brother Shaggy Oyibo talk say, patience na virtue is okay thank you The same kpo wey we smoke write better music Some other artiste smoke am wetin dem sing stupid Are you feeling me? Or should I repeat No be everybody be your man inside this street Boiz don fall person because of yeye pick up For my present police throw am for pick up Okiemute come area we ask am wetin sup For like 2 days ah swear my guy no gree talk Only to hear say he say where dem carry am go Dem give am knife shook mirror but nah him mama show He say he nor fit use him mama na him make am discharge Say around 10 o’clock for night he enter road come Lag Forgetting say everything wey dey happen for Accra, area don hear the real gist ah wan laugh belle scatter (GRAHAM D) Because E work for Mr A like that No mean say E go work ki for Mr B like that Because your friend travel go Ghana en make him money You think say if you travel you go make am too Use your sense waka no be leg The hustle wey we dey so na God abeg If not for the Street, boiz for dey beg Na only God fit to change leggedis to Benz Akaraka di iche Akaraka di iche Weluche gi ga ije oooh no Every mallam with him kettle And every body with him grace (X2) Omo nah so E just be mehn!! Which day here ah say Okiemute for Mega Chicken Ah dey call am he dey dodge (dodge) Ah nor understand this guy E nor dey, E nor dey Who naked nor dey shook hand for pocket Nah real matter be this mehn!! Another problem with our young boiz be say dem go dey compare their one step to another man one hundred step (real matter my guy) If you no get money no hide your face ooh Show your face make person help you Na so life just be (na so life just be)…
clip
Ton pseudo sera publié. Laisses les champs vide pour rester anonyme.
Soumettre
Modal title
×
Ajouter un média
Video URL?
(YouTube, Vimeo, Instagram, DailyMotion, Soundcloud)
×
Se souvenir de moi
Mot passe oublié
Connectes-toi
M'inscrire